Pages

5 Dec 2012

LAGOS AGBERO

KontriMan wey don move for Lagos, don get one experience or the other with either agbero or conductor. Either say conductor wan use agbari so you go forget your change or conductor don abuse or curse or probably even wan fight you sef over some trivial matter.
Even the way wey them dey pronounce bus stops (like Ayege instead of Agege) no go make you sabi say you don reach where you dey go (except you actually know where you are going to and not asking for directions).
On his own part, Agbero go wan prove say na him get road or bus stop. If conductor no pay money for loading or booking or even security, yawa go gas. he go find something comot for the bus body like mirror or wiper.
Movement for Lagos public transport na with power. Now wey okada no even dey again for a lot of places. Na Baba God go help us o!
Lagos nawa oooh!

No comments:

Post a Comment